Wia dis foto come from, Getty Images
Match day three of Fifa world cup qualifiers for Africa see some interesting results.
Nigeria come from behind to play 1-1 wit South Africa for Uyo, di result mean say group C still dey wide open.
Di north versus south match between Morocco and Zambia see di north African giants win Chipolopolo 2-1 in Agadir to retain dia lead for group E.
While reigning African champions, Cote d’Ivoire beat Gabon 1-0 to take number one spot for group F.
Each of di nine African qualifying group winners go qualify for world cup and di four best teams wey finish for second go den play for play off spot for intercontinental tournament wia di final two go qualify for United States, Mexico and Canada.
End of Recommended articles
See how di African group table Fifa world cup qualifiers.
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Di first two matches for each group dem play am between 15 and 21 November, while rounds three and four dey take place dis June.
Di remaining six match days of World Cup qualifiers dem go spread am across di international windows for March, September and October 2025.
Sunday 9th June
Group A
Group B
Group H
Monday 10th June
Group A
Group C
Group E
Group G
Group H
Group I
Tuesday 11th June
Group B
Group C
Group D
Group E
Group F
Group I
Caf don cancel di traditional preliminary round wey dem bin dey use bifor.
Di new plan go see all African nations take part for a larger group stage – di 54 entrants dem split dem into nine pools, each group get six teams.
But, Caf plans spoil afta Eritrea late withdrawal from qualifying on 10 November, now Group E get only five teams.
All di kontris wey top dia qualifying group go automatically book dia place for United States, Mexico and Canada tournament.
While some of di (runners-up) dat one mean second position for table of di nine qualifying groups go get another chance to reach Canada, Mexico and USA.
Di four best-ranked second-placed sides go play for play-offs, wey go see dem play semi-final and final for November 2025 to determine which African side go advance to di intercontinental play-off tournament.
Eritrea withdrawal go affect dis rankings, Caf neva tok yet how dem go take solve dis matter.
Di final global qualifying round go involve six teams wey go compete for di final two places for di 2026 finals, and e dey expected to take place for March 2026.
© 2024 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source