Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria Football Federation (NFF) don confam di appointment of Éric Sékou Chelle as Head Coach of di Super Eagles.
Chelle appointment na wit immediate effect and im main work na to carry di Super Eagles go di 2026 FIFA World Cup finals, according to NFF.
Di federation say dem reach dis decision to hire a foreign coach for di Eagle for dia "meeting wey hold for Abuja on Thursday, 2 January 2025."
Dat na wia di NFF Technical and Development Sub-Committee recommend di appointment of di former Coach of di senior men national team of Mali.
NFF say Chelle mandate na to carry di Super Eagles of Nigeria go di 2026 World Cup.
Wia dis foto come from, Getty Images
Eric Chelle no be name wey dey popular for African Football like George Weah, Abedi Pele, Samuel Eto'o, Rashidi Yekini and di rest.
Dis na becos im football career no too loud.
As a player, Chelle bin play for di Mali senior national team only five times.
Im also play for mostly French clubs like Martigues, Valenciennes, Lens, Istres, and Chamois Niortais.
Meanwhile, Chelle don surprise many pipo as a coach. Bifor e become di national team coach of Mali, Chelle bin manage a number of clubs for di French lower league.
Di 47-year-old get coaching experience wit GS Consolat, FC Martigues, MC Oran and Boulogne.
Na for 2022 Mali appoint am as di senior team coach and like play, like play e carry Mali go di 2023 Afcon wey Côte d'Ivoire host.
For di tournament, di Aiglons of Mali reach di quarter finals bifor dem lose to di host nation for extra time. Côte d'Ivoire go on to win di tournament.
Video show as Chelle squat and dem begin pour am water for head afta di loss – im emotional reaction later become one of di highlights of Afcon 2023. Dem sack am on 13 June, 2024.
Wia dis foto come from, BBC Sport
To coach Nigeria no be small work.
Dis na becos di kontri wit plenty talented players wey dey play for top European clubs dey struggle to win games for di continent.
Many pipo don trace Super Eagles failures to say, na becos dem neva get beta coach wey fit connect di plenty talent wey di squad get.
Several coaches don come and go – both foreign and local but di big kwesion now na if Eric Chelle na di answer to di problems wey di Eagles get.
NFF for dia statement say Chelle mandate na to qualify di team for di 2026 Fifa Wold Cup.
Nigeria dey fifth place in Group C of di 2026 World Cup qualifiers wit three points. Dis na afta dem struggle against di likes of Benin and Lesotho.
Chelle first set of games na di 2026 World cup qualifiers matchdays five and six for March.
Weda e go fit do magic na wetin pipo go dey watch.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source